Authorities for Nigeria don demand $10 billion dollars as penalties from di biggest cryptocurrency exchange platform for di world, Binance.
Dis na sake of di allegations say di cryptocurrency platform dey cause massive losses for di kontri becos dem dey fix exchange rate.
Di goment say Binance don influence di increase in foreign exchange rates through how dem dey speculate di currency for di kontri wey don make di Naira fall by almost 70% in recent months.
Bayo Onanuga, one of di tok tok pesin for president Bola Tinubu say goment bin see di effect of Binance operations for Nigeria.
“Di platform dey fix di exchange rate for di kontri and na illegal rate. Di CBN na di only authority wey fit fix exchange rate for di kontri.”
“Binance platform dey harbour pipo wey dey fix di exchange rate wey quickly affect di Nigeria economy for di time wey Nigeria dey try stabilise di economy.”
On Thursday, Nigeria goment confam di arrest of two foreign Binance executives wey security agencies don dey question ova di allegations say di platform dey assist in money laundering, and financing terrorism among oda allegations.
Di govnor of di Central Bank of Nigeria Olayemi Cardoso bin tok on Tuesday say about $26 billion bin pass through Binance Nigeria in cryptocurrency trades.
Di CBN govnor tok say many of di trades for cryptocurrency na through “sources and users wey we no fit adequately identify”.
Onanuga say Binance dey cause disruption for di economy and di goment no go fit fold dia hand to allow make e kontinu but di officials don begin dey cooperate.
“Binance staff dey cooperate wit di goment to provide information”, Onanuga tell BBC Newsday programme on Friday.
‘Binance, odas no get presence for Nigeria’
Onanuga tok say Binance and oda cryptocurrency companies no register according to di laws of Nigeria. For 2021, di former CBN govnor Godwin Emefiele say dem no go eva accept cryptocurrency until 2023 wey goment lift di ban.
Di president tok tok pesin say Binance don comot naira transaction from dia platforms as dem dey also cooperate wit goment to supply plenty information.
“CBN bin lift di ban ontop cryptocurrency but dem gatz dey registered according to our law, dem gatz go di Security Exchange Commission (SEC) so dem go fit get presence for Nigeria but Binance and oda crypto companies no get and no dey registered according to our laws.”
“Goment say if dem wan operate for Nigeria, dem gatz register. Goment dey follow dem tok and dem dey give a lot of information, naira no longer dey dia platform again and nobody fit do naira transaction on dia platform,” Onanuga add.
Onanuga say “goment dey ask for small money, we dey ask for close to $10 billon in damages wey almost mess up our economy in very short time.”
Nigeria goment say di CBN na di only authority wey fit fix exchange rate for di kontri but Binance platform dey harbour pipo wey dey fix di exchange rate wey quickly affect di Nigeria economy for di time wey Nigeria dey try stabilise di economy.
“Our budget dis year na 800 naira against di dollar but di rate don high pass and na di pipo wey dey binance cause am. Pipo wey dey operate di parallel market tok say if we no clampdown on Binance, our naira go enta serious problem.
How long investigation go take?
For one interview wit di BBC, Zakari Mijinyawa, wey dey head di press department of di Office of di Nation Security Adviser to di President, say di executives dey under investigation.
“Di officers dey undergo questioning under di investigation by di security agencies ontop di regulation of di currency exchange market.”
Mijinyawa tell di BBC say “discussions and agreements dey go on wit Binance officials, and dem dey cooperate.”
However, di official no give detail information on how long di investigation go take. Dem no also reveal di agreement wey dem dey discuss between di goment and Binance.